Burna Boy
Página inicial > B > Burna Boy > 20 10 20

20 10 20

Burna Boy


Theelements

Shey you never hear
About the things wey happen there
Abi your eye never clear
Mankind so wicked
Lets talk about my government open your mind and your ears
Wetin happen, shey na jazz o
Make my people suffer suffer
All their nyanshes don dey open everything don scatter scatter

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so water woo watеr
Runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify thе case of their murder

The chief of staff, the commander
and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo Ijoba
All your atrocities
All of your corner corner
Make all the dead body disturb you for your dream

The money wey you thief yapa for your azza
You don turn our graduates to common beggars
All the book them go no matter
Cuz you no go get job if you no know godfather

The chief of staff, the commander
and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo Ijoba
All your atrocities
All of your corner corner
Make all the dead body disturb you for your dream

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so Water OO Water runaway my eyes
Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

We give them many chances dem fail my people
And when we cry for justice
Them kill my people
Walahi all of you
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths
Wey die for tollgate

Encontrou algum erro na letra? Por favor, envie uma correção >

Compartilhe
esta música

Ouça estações relacionadas a Burna Boy no Vagalume.FM
ESTAÇÕES